Wia dis foto come from, Getty Images
At least 25 African kontris fit face partial or total US travel bans inside one new anti-immigration measure by US President Donald Trump administration, Reuters report.
According to one internal State Department memo wey Reuters see, America goment wan extend dia travel restrictions on 36 more kontris, wey go potentially ban citizens of these kontris entry into di US.
Di State Department bin raise concerns on top security, lack of cooperation on deportation of nationals and overstaying of visas among di kontris under review ova di next 60 days.
“Di Department don identify 36 kontris of concern wey dem fit recommend for full or partial suspension of entry if dem no meet di established conditions and requirements within 60 days”.
African kontris wey dem dey reportedly chook eye include:
If dem carry out di ban, e go be significant expansion of di travel ban wey di US goment impose earlier wey affect at least 10 African kontris.
Dis go mean say 2/3rds of African kontris go dey affected by di travel restrictions.
Among di concerns di State Department bin raise na lack of a competent or cooperative goment by some of di kontris dem mention to produce reliable identity documents. Anoda concern na “questionable security” of dat kontri passport.
Tori be say some kontris no dey cooperate in facilitating di removal of dia nationals from di United States, nationals wey di US order say make dem remove.
Some oda kontris dey overstay di U.S. visas dem give dia citizens.